I believe say everybody want make dem see am, make dem hear am, and make dem love am. Dis one na everybody right.
I believe say everybody na the same thing. Nobody big pass anoda person.
I believe say dis world wen we dey na for everybody, so e go must contain everybody.
I believe say everybody sabi something patapata e go be one thing.
I believe say I dey special, na so everybody for dis world dey special, you no be two, na only you.
I believe say everybody get im good side and im bad side. So me I go dey try make I see say na only the good side I go dey bring come out but dat bad side, I go control am well well.
I believe say the place where I come from, the religion Wen i dey practice and dis divide Wen dem dey divide pipu up and down no mata at all. Na pipu Wen get evil mind dey divide pipu so dat the rich man go dey suppress the poor man. Weda you be rich man or poor man, all of us dey equal, nobody big pass.
I go dey treat pipu the way Wen i want make pipu dey treat me.
I no go dey follow person as im dey do, I go dey follow am as I want make im dey do.
I no go do any wuruwuru business or project Wen i know say e go bad for another person.
I no go dey judge pipu again, I go undastand dem first.
I no go allow jealousy and long-throat control me lai lai.
Bifor I die, I go must do one good thing wen pipu go take dey remember me.
Even though say I dey pass through trial for dis life, I go try to endure am, take dat time learn something Weh go help me for dis life.
I no go fear anything so far I dey do the right thing.
I no go dey tink bad bad things for my mind but I go try to dey tink good good things bicos the things wen we dey think, na im dey happen to us.
I no go dey copy copy oda pipu, me sef na original and correct.
I believe say if I put my mind for something, do am well well, I go must make difference.
I believe say dis life Wen we dey, no be competition, no be race, na jejeje I dey Waka.
I believe make peace dey everywhere.
I believe say make we dey help each oda.
I believe say make we dey forgive each oda after all nobody dey perfect.
I believe say make we love ourselves well well.
I believe say make pipu dey pity for anoda person. Make we dey get soft mind.
I believe say make we dey judge every body the same thing.
I believe say human being go beta.
I don decide say me go enjoy dis life well well, no be to sidon dey look o.
Me wen be don gree say I go dey do as I don talk everyday of my life.
My gratitude goes to who put this together. I appreciate what you are doing for the community. Keep it up.
THANK YOU FOR STOPPING BY MY NEIGHBOURHOOD.