I carry yansh for all of una here. I dey hail o!
My name na aka writing steamstress aka my mama pikin... Nna, my title too plenty make I stop dia. I be senior zuzu for here but I don chop awoof plenty plenty.
PHOTO SOURCE: PHONE GALLERY
Na like ds I take sabi steemit;
Na one aproko friend like dat yarn me wertin dey sup for steemit but me no even wan give am green light for the gist. Ds aproko friend worry me so tey, him even appear for dream dey cari steemit paper logo show me. My broda and sista, as I open eyes, na so I find steemit come so.
Before I sabi steemit, ponzi pipu don cari my moni build house, buy motor and marry join.
E no go better for dem.
But as I de cry for night, steemit come like joy for morning. Chei! Steemit na better boyfriend I swear, him don learn me beta english, him use mix cement, cement my grammar n syntaxes. Him no just stop dia, him cari me go show dem senior men and women for area like ,
and
etc etc, I follow dem de yarn like girl-girl and Oga-Sir.
Him (steemit) use my 1st post payout break my virginity and I no regret am at all. I settle my school fees wahala . One hungerman lecturer wey comot textbook say make we buy am for 5k, I no argue, I jejely comot my money buy the book. I for don complain like my classmate but my sweet bobo(steemit) been show me joy. Thunder fire poverty! Dia fada! Twale to my boyfriend ooo.
PHOTO SOURCE: PHONE GALLERY
My pipu, make I come dey go. Be like say my sweet bobo (steemit) don de find me.
My kountry pipu una wehdone o!