E don happen again o, this one na the kind thing wei we fid refer to as;
green snake for green grass
Why i tok so be say,this kind pesin go blend wella with u sote u fid no suspect am sef.
So my own tori na this. E get one very fine girl like that i bin take as my friend,infact we just align for most mata,unto school stuffs.
But i come realise say,as me don jeje take am wholeheartedly as my friend wei i fid call sista sef,the truth be say she no take me like that.
E get one thing we bin wan do togeda,i bin tell am sai me no ger money to do am now,but as u go meet the pesin we go fid help us do am abeg tell am sai na u and your paddy o.
So when i come get the money wan do the transfer, i come realise say,she bin no even carry me along. The thing bin pain me ehnn.
So na so i bin sidon,think sai i get pesin wei i fid trust,and i no know say na lie.
The ting wei pain me be say,when i come ask am,she no even show remorse sef,she com prove gimme like say na me be dey fault.
E bin pain me ehn,sote i fear say this kind pesin fid go behind me do bad ting wei fid change my destiny,make I kukuma leave am now e neva reach had I known tori.
So my fellow steemians,make una dey careful,the kind pesin una trust,cause e fid be lie.