Naija I hail o!
To others, this no be una regular type post at all. If you sabi wetin I dey yarn, you fit read on or else, well, the whole story go just dey like Greek for your eye.
Naija and Language
So every small thing wey we talk about language, people go dey hala say Naija no get one language, Naija this, Naija that. But if you think am well, how you dey take follow that bike man talk? Ehn, that one wey no follow come from where you been come.
If you enter market for Lagos, how Igbo dey take follow Yoruba talk? How Yoruba dey take follow Hausa talk? You suppose don get answer to these my plenty questions now o.
The Truth
We don get national language since but we just no wan gree. E be like say na the same habit wey no gree allow us buy Naija things no want make we accept say Pidgin fit be our national lingua.
E fit be say many people think say na only people wey no go school dey blow Pidgin. One small journey inside any school for Naija go show say that one na big lie. E fit be say na people wey no go school start to dey speak Pidgin but as our people dey talk, no be who call police dey win case.
E mean say person wey start am no matter, things wey happen for past no follow for where present tense dey. We suppose look how many people dey speak Pidgin now plus the kind people wey dey speak am before we start to dey conclude say na dem illiterate dey speak Pidgin.
Wetin We Wan Do?
E don tey wey I been wan turn Pidgin to legitimate Naija language. I been get idea wey go allow people contribute words, phrases, them meanings and dem spellings (una see wetin I do for there?). Because as things dey now, Pidgin na more of oral than written language. If we really want make the language grow and mature, we gaz get official spellings, plus we suppose get our own dictionary sef!
Na since 2009 or so wey I don get this idea and as I no take do anything on top am, the idea go hibernate but as I just dey my bed today, the thing come back.
Shey Steemit Fit Help Pidgin Mature?
E be like say the possibility dey wey we go fit use Steemit organize the whole thing. I never really think am well so no concrete plans dey but I feel say I need take the first step, which na to put the gist out for una.
Language no fit mature if e no get e own dictionary. Structure and pronunciation fit join later but the first step na to gather words, phrases, and spellings.
So I wan hear una ideas. How una think say we fit use Steemit grow Pidgin to the level wey we go fit dey yarn say jungle don mature?
If you got to this and you're still wondering what the f you just tried to read up there, I mean, it looks like English but as soon as I start reading, it gets all messed up. Well, you just had an encounter with Pidgin.