On top my side if persin wey feel sey him don chop beleful go touch my mama na die be dat nai.
If you d younger dan my mama n she no dey wrong your own don finish partata on the oda hand if she dey wrong I go still change am for you but when we leave dei eh I go call my mama tell sey wertin she do no good.
If nai persin wer senior my mama n she no dey wrong nai to carry army n police follow am but if my mama dey wrong I go still arrest am with Police for assault.
Anyhow anyhow person touch my mama wrongfully or rightfully him must pay.
Nai my own submission be dat.
RE: PERSON SLAP YOUR MAMA, WETIN YOU GO DO?