, me sef tire 4 dis kind mata o,wia old man go dey flog small pikin koboko by force...but d mata na 2 ways sha. u know say oyinbo version dey n black man version sef still dey. Make i try analyse both versions 1st, b4 i make my conclusion.
Oyinbo version make us realise say dis kind thing na psychiatric case weh dem dey call paedophilia. N anybody weh gt dis kind disorder, dem dey call dem pedophile. But my question now na say, wetin dey cause dis kind mumu disorder or au peson take dey get am?
From d black man perspective, na d winch pple 4 d man village dey folo am 4 bak. But mk we reason d tn well tru tru,wetin go mk mature man dey go folo small pikin do dat kind tn wen better babes dey weh set, if d man no fit spin babe sef, red light district dey everywia weh e fit just enter,pay money n free him waist.
But na my own point of view b dis sha as peson weh go skul small, dem suppose chek dat kind man brain tru tru weda e dey ok as dem talk say na psychiatric disorder, anytn dem come out with, mk dem use attend to d man, mk we no dey attach evrytn to winch mata, n also mk dem try rehabilitate d pikin weh dey get dis kind experience mk d trauma 4 no affect dem truout dia life.
, i hail o....
RE: THIS MAN MUST DIE