My country people for obodo naija pidgin i drop my salute o... I know say to lie na bad tin and e no get reason wey de enough to justify your lie. As human being at one point in time we go gat lie. So today i wan share one lie wey i drop wen i de small.
When i enter JSS1 dat year, i been de play like say tomorrow no de. Base on say i feel say na like nursery school wey you go just use intuition take pass. As result comot for first term, i fail jack leg. Na so i blow lie give my parent say na government the compile the result say dem neva release am because na government school. With de hope say i go pass for second term. Second term come worst i fail again. Na de i go report myself o... I chop beating that day sha, but after that na so mumsi keep me down drill me, the next term and the terms ahead i did excellently well.
The moral lesson be say lie no the help, if to say i come out plain i for no fail again and i for no chop that beating because them no flog me because i fail na because i made them look like a fool with my lie. So na so the tori be, no matter what make you try talk the truth.
RE: LIE WEY DEY MAKE DEVIL BOW